We no send at all
wether the world dey bend
even we dey crawl
we must to reach the end
coruption na our sister
e full our back yard
jealousy na our brother
dem help us play the card
All of us dey hustle
and no body dey slack
we drink suffer from bottle
upon say we no lack
We run dey go away
some say e go beta
every koro wey you dey
our mother land tanda.
Emmanuel Odum
http://www.poemhunter.com/poem/naija-style/